Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.
Na pipol wey nor dey faithful, full di land and dem dey live wiked life kon dey use dia pawa anyhow. Di pipol dey mourn and all di green leaf don dry, bikos God don curse dia land.”
But I si sey na Jerusalem profets own worse pass; dem dey sleep with who dem nor marry; dey lie; dey enkourage pipol to do bad tins, so dat dem nor go stop to live dia wiked life. To mi, all of dem bad and wiked like Sodom and Gomorrah pipol.
As Jehudi read three or four line finish, di king vex, kut dat part for di book komot with knife kon trow am for di fire. Na so e do until e burn di whole book finish.
Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
Una dey use una lie take diskorage good pipol; pipol wey I nor like to ponish. Una nor let evil pipol shange from di bad tins wey dem dey do, so dat dem go dey save.
I go use lantan take find all Jerusalem korna wey darkness pass, so dat I go ponish doz wey love to sin. Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin; weda good or bad.