16 Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol, dem go praiz am and afta E don judge all of dem, evribody go know sey Oga God get pawa well-well.
Yu dey great and get pawa; Yu get glory, honor and respet. Evritin for heaven and eart, na yor own and dis na yor kingdom. Wi dey praiz Yu pass evritin for dis world.
For dat time, yu go sey: “Make wi tank God! Make wi praiz en name! Make wi tell evribody about di tins wey E do! Make wi tell dem how God big and strong rish.
Na justice dem go take measure di foundashon. And na trut dem go take build am.” Big-big stones go fall kon kill all di pipol wey dey lie well-well and wota go distroy all di place where dem tink sey dem dey save.
Wen una go si di shidren wey I go give una, den una go know sey na mi bi Israel God wey dey holy and una go honor my name. Una go honor mi wey bi una King. Yes! Una go respet Israel pipol God.
Bikos of dis, God dey ready to pity for en pipol; E sidan for en throne and E dey ready to forgive una. True-true, God dey good and evribody wey get faith and dey wait am, go happy well-well.
Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
Afta I don bring una kom back from di kountries where I skata una go before, I go asept di sakrifice wey una go give and evribody go si sey I dey holy.
Tell di pipol for der wetin mi God wey get pawa dey tell dem: “Sidon pipol, I bi una enemy and pipol go praiz mi, bikos of wetin I go do una. Dem go know sey na mi bi God wen I don show as I holy rish and afta I ponish evribody wey dey stay Sidon.
God wey get pawa sey, “I go bring Israel pipol kom back from di kountries wey I skata dem go, den all di kountries go know sey I dey holy. Israel pipol go stay for dia own land. Di land wey I give my savant Jakob.
Wen I show di kountries how my name dey holy and great rish; di name wey una dey disgrace, dem go know sey na mi bi God. Mi, God wey get pawa, don tok.” “I go use una take show di kountries sey I dey holy.
Yu and yor pipol go attack my pipol like strong kloud wey dey pass di land. Wen di time don rish, I go send yu go skata my land, so dat dem go know who I bi and dem go si as I holy rish, bikos of di tins wey I go do thru yu.
Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.
Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.
But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.
“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Filadelfia: ‘Di Pesin wey dey holy and true, wey whole David key; wen dis pesin open door, nobody go fit klose am and wen e klose door, nobody go fit open am.
Each for di for creatures get six feada and eye full di feadas. Dem nor dey ever rest for nite or day and dem dey always sey: Holy! Holy! Holy! Na-im bi di God wey dey mighty. Di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go soon kom.