Isaya 5:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English12 Yes! Una dey play harp, tamborin, flute and dey drink wine for una party, but una nor undastand wetin God dey do, အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
Instead, yu dey against God wey get heaven and eart. Yu bring all di tins from di temple, den yu and yor men, plus yor wife and yor girl-friends kon use dem dey drink wine. Yu dey praiz di gods wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone; gods wey nor even fit si, hear or undastand! But yu neva ever praiz God wey dey kontrol yor life and ways!
Wen dis pipol dey follow una chop di fellowship food wey God don bless, dem bi like shuku-shuku for una body. Dem bi like shepad wey nor dey shame, bikos e kare for only ensef. Dem bi like kloud wey just dey blow, but rain nor dey fall. Dem bi like tree wey nor get fruits and God don rut dem komot from groun.