Di head for each family for Judah and Benjamin tribe, di priests, Levi pipol and evribody wey God tosh dia heart kon go back to Jerusalem go build God Temple.
Den I leta tell dem, “Make una si di kind trobol wey wi dey face, bikos Jerusalem don skata and en gates don distroy! Make wi ribuild di town wall, so dat shame go komot from awa eye.”
Una kountry skata and evribody bin run komot der, but naw, e go dey too small for una pipol. And doz wey leave una wen una dey face wahala, God go remove dem from una forever.
Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.
Make una look round kon si wetin dey happen; una pipol dey gada kom house! Una shidren go kom from far place; dem go karry una girls for shoulder kom back.