I go send viktory kom from di sky like rain, so make di eart open and receive am; so dat salvashon and korrect judgement, go grow. Mi, wey bi God, go make dis tins happen.”
Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.
I nor go rest bikos of Zion and bikos of Jerusalem I nor go kwayet until en raitiousness go shine kom out like morning lite and en salvashon like tosh wey dey shine well-well.
God sey, “I go make una prosper forever; all di nashon propaty go kom meet una like river wey nor dey dry. Una go bi like pikin wey en mama kare and karry for hand kon trit am with love.
I sey, ‘Make una plant raitiousness for unasef, den una go harvest love wey nor dey end. Make una klear new groun for unasef, bikos dis na di time to turn kom meet mi, so dat I go save una.’
“O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kill di profets and stone di pipol wey God send kom meet una! I don dey try to gada una shidren as fawol dey gada en shidren under am, but una nor let mi do am.