11 Na bikos of mi, I dey do am. Yes! I dey do all dis tins bikos of mi. I nor go fit let una spoil my name. I nor go let anybody share my glory with mi.
Make Yu nor remember di sins wey I kommit wen I yong. Remember mi for di lite wey yor love wey nor dey fail dey bring, bikos Yu my God, dey sorry for pesin.
Di same tin don happen naw for Babilon, una don bi slave and dem nor pay anytin for una head. Pipol wey dey rule una dey make mout and dem dey always use my name make yeye.
Den I ansa, “My God, even doh awa sins dey tok against us, make Yu kom save us bikos of di honor for yor name. True-true, wi don turn from Yu many times and sin against Yu.
God wey get pawa sey, “Israel pipol, make una dey do wetin una like! Make una kontinue to serve una juju! But I dey warn una sey, afta una don serve juju finish, una go must obey mi kon stop to rijet my name wey dey holy, bikos una dey ofrin to juju.
“Naw, make yu go tell Israel pipol dis message wey mi God wey get pawa get for dem: Wetin I won do nor bi bikos of una, but na bikos of my holy name; di name wey una don disgrace for evriwhere.
“So naw, God, make Yu hear my prayer and as I dey beg Yu. Make Yu sorry for yor temple wey dem don distroy; so dat evribody go know sey na only Yu bi di God wey nor dey die.
so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.