Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 47:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Yu sey, ‘I go bi kween forever.’ But yu nor tink about dis tins or tink about wetin go happen.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 47:7
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Fero go inside en house back. E nor even allow wetin happen worry en mind.


So E make us si how E dey vex kon make us sofa di pains. En vexnashon dey burn like fire for evriwhere for Israel, but wi nor know wetin bin dey happen and wi nor still learn anytin from am.


“Babilon, sidan for darkness and make yu kwayet, bikos pipol nor go koll yu kween again!


Raitious pipol dey die and nobody undastand or even kare. Betta men dey die, yet nobody dey si di evil wey dey kom.


God sey, “Who bi all dis gods wey make una dey fear and lie for mi? Wey make una forget mi like dis? Una don stop to honor mi, bikos I don too kwayet?


Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?


E nor keep ensef klean or tink of wetin go happen to am. Naw, e dey inside gutta and nobody won bring am out. So e kry kon sey, “Oga God, make Yu si wetin dey happen to mi; my enemies don win mi.”


“Man pikin, go tell Tyre king wetin mi God wey get pawa dey tell am: “Yu dey proud and yu dey sey yu bi god wey sidan for throne and sea dey round yu. Yu fit pritend sey yu bi god, but make yu know sey na human being yu bi and nor bi wetin yu tink.


Tell am sey dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Yu wey bi juju for wota, I bi yor enemy naw. Yu sey na yu get and kreate Nile River abi?


“Man pikin, dis na wetin mi wey bi Oga God dey tell Israel pipol. Di end don rish for evriwhere for di land!


Afta twelf monts, as e dey waka for di roof for en palis for Babilon.


Mi wey bi Nebukadnezzar dey live for peace for my palis, I dey enjoy betta tins.


How I wish sey dem get sense and fit undastand dis tins or know wetin go happen to dem.


As e karry ensef up, dey enjoy yeye life, na so di sofa and sadnes wey yu go gi-am, go plenty rish, bikos e tok for en mind sey, ‘I dey rule like kween, my husband neva die and I nor go ever si sadnes again!’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ