Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 47:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Naw, make yu dey use yor majik well-well; majik wey yu dey use since dem born yu. May bi e fit help yu or yu fit use am porshu trobol!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 47:12
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make Israel pipol sey, “Na since wi dey small awa enemies don dey opress us.


Fero sef tell en native doctors and juju-men for Egypt sey make dem do di same tin.


Di juju-men sef kon use dia juju pawa take bring frog join di ones wey dey di land.


Di juju-men nor fit stand for where Moses dey, bikos of di boil wey full dia body and Egypt pipol own.


I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles. Dem go-go meet dia juju for help kon tell doz wey don die make dem advise and ansa dem.


Na mi dey fool pipol wey dey si vishon kon make dia work taya dem. I dey shange wise pipol advise to anoda tin kon turn dia wisdom to foolishness.


But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.”


Where di gods wey una make for unasef? Wen ever una dey for trobol, make dem kom save una if dem fit! True-true, di gods wey dey Judah many like di towns wey dem get.


Mi, God wey get pawa, don tok. “So, make una remove una crown and di fine skaf wey una tie for head. Una life nor go bi as e bi before. I go honor doz wey dey honbol kon disgrace doz wey dem bi dey honor!


Wetin di king dey ask for, nor dey eazy. Nobody for dis world fit tok di king dream escept di gods, but gods nor dey stay with human being!”


so di king kon sey make dem koll all di majishan; doz wey dey si vishon and di wise men, so dat dem go tell am wetin en dream mean. Wen dem kom, dem kon tell di king make e tell dem di dream.


Si, dem bring di wise men and majishan kom here make dem read wetin dey di wall kon tell mi wetin e mean, but dem nor fit read am tok-less of to know di meaning.


Den shame and disgrace go follow una pipol wey dey si vishon. Una go kover una face, bikos God nor go ansa una.”


All dis tins dey happen, bikos Nineveh pipol too do ashawo, dem don sharm odas nashons and make dem dia slave.


Wen di donkey si God angel, e waka near di wall kon press Balaam leg against am. Den Balaam beat am again.


And instead of dem to turn kom meet God, dem still dey kill pipol; do majik; dey sleep with who nor bi dia husband or wife and still dey tif.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ