Afta e don tink am well-well, e make two melu image with gold kon tell en pipol, “Israel pipol, e don tey wen una dey go woship for Jerusalem. Naw, make una si di god wey bring una kom out from Egypt!”
Dem get hand, but dem nor fit tosh or feel anytin. Yes! Dem still get leg, but dem nor fit waka. Dem even get trot, but dem nor fit klear am or make any sound.
Dem kwik-kwik turn komot from di way wey I kommand dem o-o! Dem melt gold take make melu for demsef and dem don dey bow and offa sakrifice to am sey, ‘Israel pipol, dis na awa god wey take us komot from Egypt.’ ”
God sey, “Una wey survive for di nashons, make una gada kom! Pipol wey dey waka for evriwhere with di wood juju wey dem dey serve kon dey pray give oda gods wey nor fit save dem, nor know anytin at-all!
All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.
Na silva and gold from Spain and Ufaz dem take kover di juju. Na doz wey sabi karve make am with dia hand kon dress am with violet and purpol klot wey dem weave.
Wahala go kom di land and all di rivers go dry finish. But, wetin make all dis tins dey happen? Na bikos juju full di whole land and di pipol love dem well-well.