Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 46:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 God sey, “Na who una fit take kompare mi? Make una tell mi, abi e get anybody wey fit bi like mi?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 46:5
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na who wi go take kompare di Oga awa God wey sidan for di high throne?


My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!


My God, na who pipol won take kompare Yu for all di heavens? E get any angel wey bi like God?


My Oga God wey dey rule evriwhere! Nobody dey strong like Yu, bikos Yu always dey do good.


My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?


Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?


Who dem go fit use take kompare God? E get anybody wey bi like am?


Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. En name na God wey dey mighty.”


wey bi sey, even doh en with God na di same, e nor boast about am.


God wey wi nor dey si, na Jesus bi en image and for evritin wey E kreate, na Jesus bi di first.


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Dem dey woship di dragon, bikos na-im give di beast pawa to take rule. Dem dey woship di beast sey, “Who bi like di beast? Na who fit follow am fight?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ