4 Even wen una don old kon get white hair, I go still dey kare for una. Na mi kreate una, so I go support, help and save una.”
Bikos na so God bi! Na-im bi awa God and E go guide us forever and ever.
Na Oga God get all di praiz, bikos na evriday E dey karry awa wahala. Na-im bi di God wey diliver us.
Naw wey I don old well-well, make Yu nor leave mi. Make I tell dis new generashon and all doz wey dey porshu mi about yor pawa.
Naw, for my old age, make Yu nor rijet mi. Make Yu nor leave mi wen I nor dey strong again.
Dem go still dey produce fruit for old age! Dem go dey strong and fresh well-well.
So, na who do all dis tins? Na who tok how generashon go bi? Na mi wey bi God; na mi bi First and na mi bi Last.
Even before I kreate di day, I bi who I bi and nobody fit eskape from my pawa. Na who fit shange or skata wetin I don do?”
But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.
Jakob shidren-shidren, make una listin to mi! Israel pipol wey I don koll, na mi bi God: na mi bi di first and na mi still bi di last.
Oga God sey, “I hate divorce. I hate wen one pesin among una do dat kind wiked tin against en wife. Make una make sure sey, una nor break di promise wey sey una go always dey faithful to una wife.”
“Na mi bi God and I nor dey shange. Una wey bi Jakob shidren, na mi make una neva die finish.
God nor dey take back wetin e don already give pipol or shange en mind about di pipol wey E don choose.
and for di wildaness where E for karry us like man wey dey karry en pikin. Na like dis E dey do for evriwhere wey una go until una rish dis place.”
and like klot and koat, God go fold and shange dem, but God nor dey shange and en life nor go ever end.”
Jesus Christ na di same yestiday, today and forever, e nor dey shange!
bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.