Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 46:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 46:10
38 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.


E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.


E dey do anytin wey E like for heaven and eart, both for under di sea and ocean too.


But God plan go stand forever; wetin E plan, nor go shange at-all.


Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


But God sey, “Wen I finish wetin I dey do for Mount Zion and Jerusalem, I go ponish Assyria king, bikos e dey proud and e too boast.”


God wey dey lead heaven sojas swear sey, “Make una know sey na as I plan am, na so e go bi and as I tok am, na so e go happen too.


Oga God, na Yu bi my God! I go praiz yor name kon show as Yu good rish, bikos Yu don do wonderful tins and na as Yu tok before-before, na so Yu do am.


Yes, di grass go dry and flower go fade, but awa Oga God word go dey forever.”


God wey bi Israel pipol king sey: “Di gods for di nashons, make una tok wetin dey una mind. Make una kom defend unasef!


So, na who do all dis tins? Na who tok how generashon go bi? Na mi wey bi God; na mi bi First and na mi bi Last.


Even before I kreate di day, I bi who I bi and nobody fit eskape from my pawa. Na who fit shange or skata wetin I don do?”


E get anybody wey bi like mi? Make e tok am! Make e kom out kon make mout for my front about wetin don happen since I kreate dis world and wetin go still happen! Yes, make e tok wetin go happen.


So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.


I koll one eagle kom from east; from one far land, di one wey dey kom do wetin I plan. Just as I tok, na so e go bi and wetin I plan, must happen.


So, make all of una gada kon listin to mi! Wish one among una juju don tell una all dis tins before? Di sojas wey God choose go do wetin E plan against Babilon.


God sey, “I dey tok about di tins wey go happen before e happen. Den na wons I do dem and dem kon happen.


Na God wont make e sofa and en deat na sakrifice, so dat God go forgive pipol dia sins. So en days go long and e go si en shidren-shidren and thru am, God go do wetin E wont.


Na so e bi too with di word wey I dey tok; e go must do wetin I plan for am. E go must do evritin wey I send am make e kom do.


But some of una go eskape from Egypt kon go back to Judah. Den, doz wey survive go know wish pesin word happen. Weda na my own or dia own.


God wey get pawa sey, “Wetin I dey tok about, go must kom.


Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


Bikos Judgement Day dey kom wen dem go distroy Israel pipol. Wetin I dey tok naw, go really happen to una!


Anybody wey nor obey dat profet, dem go distroy am and dem go remove am from God family.


but if na from God, una nor go fit stop dem, escept una won fight God.”


So wen God won show en pipol sey E nor go break en promise, E kon swear with ensef.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ