Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 45:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 I do dis tins make evribody for di world, from one end go rish di oda, know sey na mi bi God and e nor get anoda god wey bi like mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 45:6
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sey, “Make una stand for where una dey, den una go know sey na mi bi God! Evry nashon go honor mi and evribody for di world go praiz my name.”


Den dem go know sey na only Yu bi God, di Pesin wey get pawa pass for di whole world.


So, great Zion, God hill wey dey holy, no evil or wahala go dey der again. Just as wota dey full sea, na so too God word go full pipol heart for di land.


Naw, Oga wey bi awa God, make Yu save us from Assyria pipol, so dat all di nashons for di world go know sey, na Yu bi God.”


Israel pipol, na una bi my witness. I choose una as my savants, so dat una go know, bilive and undastand sey na mi bi di only God. E nor get any oda god wey dey apart from mi. E neva dey before and e nor go ever dey.


God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.


Na mi bi God, no oda god dey wey bi like mi. I give una pawa, even doh una nor know mi well.


Naw, make yu listin, yu wey dey enjoy yorsef kon tink sey yu dey save and sikure. Yu tell yorsef sey, ‘I too mush and nobody bi like mi. My husband or shidren nor go ever die.’


I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”


From east go rish west, evribody go fear en and en great pawa. E go kom like river wey dey rush well-well and like strong breeze wey dey blow.


Na like dis I go take show all di kountries as I dey great and holy rish. Den, dem go know sey na mi bi God.”


God sey, “I go let di kountry si my glory and I go show dem how I dey judge well with my pawa.


Den, una Israel pipol go know sey I dey with una and una go sey, ‘Na Yu bi awa God and nobody bi like Yu.’ Nobody go ever laf my pipol again.”


God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ