So Oga God wey diliver Abraham, dis na wetin E dey tell Jakob shidren-shidren: “My pipol, dem nor go disgrace una again and una nor go dey shame again.
Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
So make una look heaven and eart! Di heavens go vanish like smoke, di eart go tear like old klot and all en pipol go die like fly. But wen I diliver am, e go last forever. My viktory, na di final one.
Make una nor fear, dem nor go disgrace una again. Make una nor fear at-all, bikos una nor go face shame again. Una go forget una shame wey happen wen una dey small and una nor go remember di sofa wey una sofa wen una nor get shidren.
Di sun nor go bi una lite for day time again or di moon for nite, bikos na mi, wey bi God, go bi una lite forever and my glory lite go always dey shine on una.
But I go love and sorry for Judah pipol. Mi wey bi dia Oga God, go save dem, but e nor go bi thru war, swod, bow, arrow, horse or doz wey dey ride di horse dem.”
For dat day, una nor go dey shame bikos of all una sturbones against mi. I go distroy doz wey dey boast among una and una nor go ever dey sturbon for my holy hill again.
“I tell una true word, di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end.
Na so God go save all Israel pipol just as en word sey: “Di pesin wey go save Israel pipol go kom from Zion, den Jakob shidren nor go dey do bad tins again.