Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 45:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 I go make Cyrus take akshon, I go make all en road strait. E go ribuild my town kon free my pipol wey dem karry go anoda land and nobody go pay or bribe am.” Dis na wetin God tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 45:13
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make God dey with all of una wey bi en pipol as una dey go Jerusalem go ribuild di Oga wey bi Israel God house and na-im una go woship for Jerusalem.


Yu really ansa awa prayers wen Yu show us how Yu take dey save and diliver us. Di whole eart trust Yu; plus pipol wey dey di oda side for di sea.


Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way.


God sey, “I go make Medes pipol attack Babilon pipol. Dem nor dey kare about silva and nobody fit tempt dem with gold.


Nor bi dis man distroy towns kon turn di world to desert? Yes! Na di man nor gri free en prisonas make dem go dia house!”


Na who raiz di raitious Pesin kom from east kon make am stand and rule ova nashons and kings? With en swod, e turn dem to dust and with en bow, e make dem bi like grass wey breeze dey blow.


I don choose one pesin from east, I go bring am kon attack una from di nort and e go mash una just as pesin wey dey mold tins, dey mash klay.


Na mi wey bi God choose yu to show as I good rish. I go hold yor hands kon guide yu and I go give yu to my pipol Israel, just to fulfil my kovenant. And yu go bi lite to guide oda nashons.


Na mi tell Cyrus sey, ‘Na yu bi di pesin wey go rule; yu go do wetin I wont make yu do. Yu go orda make dem build Jerusalem again kon ribuild di Temple.’ ”


“I go-go for yor front kon make hills and mountins smooth. I go break bronze gates kon skata dia iron protetor.


I koll one eagle kom from east; from one far land, di one wey dey kom do wetin I plan. Just as I tok, na so e go bi and wetin I plan, must happen.


But dis na wetin God tok: “True-true, dem go release doz wey dey prison and dem go seize wetin strong men karry kom from war. I go fight with anybody wey fight with una kon save una shidren.


Di same tin don happen naw for Babilon, una don bi slave and dem nor pay anytin for una head. Pipol wey dey rule una dey make mout and dem dey always use my name make yeye.


Jerusalem pipol, make una shaut and kry like woman wey won born, bikos dem must karry una go Babilon as slave. But God go save una for der; E go save una from una enemies hand.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ