Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 44:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 E get anybody wey bi like mi? Make e tok am! Make e kom out kon make mout for my front about wetin don happen since I kreate dis world and wetin go still happen! Yes, make e tok wetin go happen.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 44:7
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

And naw, where doz wise men wey dey advise di king? Make dem kon tok evritin wey God dey plan to do for Egypt na!


Make una tell us wetin go happen, so dat wi go know before e happen. Make una tell us di tins wey una don tok before, so dat wi go shek dem kon si as dem go take happen. Abi una go tell us about wetin go happen for future?


Make una tell us how di future go bi, den wi go know sey una bi god! Make una do sometin wey dey good or wey dey bring wahala. Make una do tins wey go make us fear!


Make wi know who tok am before e happen, so dat wi go know sey di pesin dey rite? True-true, nobody among una tok am! True-true nobody among una sey na so e go bi! True-true, nobody even hear wen una dey tok!


So, na who do all dis tins? Na who tok how generashon go bi? Na mi wey bi God; na mi bi First and na mi bi Last.


I first tok wetin go happen and den, I kom save una and know oda god don do like dis before. Yes! Na una bi my witness.


Make all di nashons gada togeda and make dem bring di pipol kom: Wish one of dia gods go fit tok wetin go happen for future? Who among dem bin tok wetin dey happen naw? Make dem bring dia witness wey go sey dem dey rite or di pipol wey go kon tell us sey dem tok di trut.


So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.


Na thru one man E make all di tribes wey dey di world and E tok di time and place where dem go find God rish,


Wen di God of all ogas give di nashons dia propaty; wen E divide evry human being, E give di pipol where dem go stay rish, akordin to di nomba wey dey for heaven.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ