Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 44:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Den, one among dem go sey, ‘I bi God own.’ Anoda one go sey ‘I bi Jakob pikin.’ and anoda one go rite God name put for en hand kon sey, I dey among God pipol and my name na Israel.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 44:5
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wetin dem rite na: “King Cyrus for Persia sey: ‘Di Oga God wey dey heaven don give mi all di kingdoms for di world. E don choose mi to build temple for am for Jerusalem wey dey Judah. Naw, make all of una wey bi God pipol go back and di Oga una God go dey with una.’ ”


“Bikos of all wetin don happen, wi promise and rite agriment kon allow awa leaders, Levi pipol and di priests stamp am.”


My God, I bi yor savant; yes, I bi yor savant wey dem born for yor house and Yu don free mi from di shains kon save mi from deat.


Dis go bi like sign wey una put for una hand and fore head, so dat Oga God law go dey una mout, bikos na with en strong hand E take karry una komot Egypt.


and pipol go dey sey, “Make wi klimb go God mountin. Yes! Make wi go Israel God Temple, den E go tish us wetin E wont make wi do and wi go waka for di road wey E choose. Bikos betta tishing dey kom from Jerusalem and God dey tok to en pipol from Zion.


I sign and pipol witness evritin wey wi do, den I weigh di money for skale for am.


Dem go ask kon follow di road wey dem dey pass go Zion. Dem go make kovenant wey nor dey end with mi and dem nor go break am.


Pipol from many nashons go kom and dem go sey, “Make una kom make wi go di Oga mountin wey bi Jakob God house, so dat E go tish us en laws and wi go do evritin just as E wont am.” Nor bi only di pipol for Zion and Jerusalem go hear God word, but oda nashons go hear am too.


I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”


Dem dey do like dis, nor bi only as wi wont am, but na bikos dem don first give demsef to God, den dem kon give demsef to us as God wont.


Una wey dey obey dis rule wey I dey give so, make peace and mesi dey with una and all God pipol.


From naw go, make nobody worry mi, bikos I get Jesus Christ mark for my body.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ