Why my pipol nor ansa wen I go meet dem sey I go save dem? Why dem nor ansa wen I koll dem? I nor get pawa rish to save dem? But I fit kommand di sea make e dry kon turn river to desert, so dat di fish dem go die.
Wahala go kom di land and all di rivers go dry finish. But, wetin make all dis tins dey happen? Na bikos juju full di whole land and di pipol love dem well-well.
Dem go cross rof river and I go stop di wave and Nile River go dry finish. Assyria wey bin dey karry body up, go honbol demsef and Egypt wey dey strong, nor go get pawa again.