Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 44:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Na only fool go make en own god – yeye god wey nor go fit help or fight for am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 44:10
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta e don tink am well-well, e make two melu image with gold kon tell en pipol, “Israel pipol, e don tey wen una dey go woship for Jerusalem. Naw, make una si di god wey bring una kom out from Egypt!”


Na silva and gold human being take make dia juju.


E nor bi like juju wey man make or di one wey doz wey dey karve wood kover with gold or put silva.


All dis gods dey yuzles; dem nor fit do anytin at-all. Di juju dem dey weak and konfuse and dem nor get pawa at-all.”


God sey, “Una wey survive for di nashons, make una gada kom! Pipol wey dey waka for evriwhere with di wood juju wey dem dey serve kon dey pray give oda gods wey nor fit save dem, nor know anytin at-all!


Dat kind juju bi like image for farm where dem plant melon put. Di juju nor dey tok; dem must karry am waka, bikos e nor get leg. But make una nor fear dem, bikos dem nor go fit wound or help una.”


Den I sey, “My God! Na Yu dey protet and give mi pawa. Yu dey help mi anytime I dey for trobol. Nashons go kom from evriwhere for di eart kon sey, ‘Di gods wey awa grand-grand papa dem get, na only to lie dem know and dem nor fit save anybody.’


King Nebukadnezzar build one gold image. E tall rish ninty fit and na so too e wide rish nine fit. Di king put di image for Dura aria for Babilon.


Wen Shadrak, Meshak and Abednego kom, di king ask dem, “Na true sey una nor gri woship or bow to di image wey I make?


Na wetin juju dey good for? Nor bi sometin wey pesin make with en hand? Na wish good e do wey go make who make am, trust am? Na god wey nor fit tok!


And una don si and hear sey dis Paul don take many pipol komot from awa hand. Nor bi only for dis Efesus, but for di whole Asia, bikos e dey tell dem sey di gods wey dem mold, nor bi god at-all.


So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ