Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 43:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Bikos na Mi bi di Oga wey bi una God. Israel pipol God wey dey holy, wey save una. I go sell Egypt, Sudan and Seba pipol, so dat una go dey free.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 43:3
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Kush shidren na Seba, Havilah, Sabtah, Rama and Sabteka. Rama shidren na Sheba and Dedan.


Tarshish kings for west and di oda kings go kon pay respet to am. Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.


Fero savants ask am, “Na how long dis man go dey trobol us? Make yu free di pipol make dem go serve di Oga wey bi dia God. Yu nor know sey Egypt don distroy finish?”


“Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave.


Pipol wey dey raitious, God dey protet dem from trobol; but trobol dey always follow wiked pipol.


Di wahala wey wiked pipol bin won kause for good pipol, na dem dey use dia own head karry am.


E go dey remind pipol for Egypt about God. Wen dem dey opress di pipol and dem koll God make E kom help dem, E go send pesin go diliver and help dem.


Afta dem seize Ashdod town, God sey, “Isaya wey bi my savant naked dey waka about for three years naw. Dis na sign about wetin go happen for Egypt and Ethiopia.


“Nor do good again, but make yu kom join us. Make yu nor tell us about di Holy One for Israel again.”


God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.


Na mi bi God and na my name bi dat; I nor go share my glory with anybody or let juju follow mi share my praiz.


Yes! Na only mi bi God; di only One wey dey save una.


God tell Israel pipol sey, “Egypt, Sudan and doz tall pipol for Seba with evritin wey dem get, go bi una own. Dem go waka follow una with shains for dia leg; bow for una kon beg dey sey, ‘True-true, God dey with una and e nor get anybody wey bi like am. Yes! E nor get any oda god.’ ”


True-true, na Yu bi Israel God and Savior and Yu bi God wey nor dey show yorsef.


So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.


I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”


Nashons and kings go kare for una as mama dey kare for en pikin. Den, una go know sey, mi wey bi God, don save una. Israel God wey get pawa don free una.


God sey, “Dem bi my pipol and dem nor go lie give mi.” E save dem


Yet, na Yu bi di only hope wey Israel get; na Yu save us from wahala. So naw, why Yu kon bi like strenja for awa land or like pesin wey dey travel kon branch stay for one nite?


Den God sey, “So, I go make dis wiked pipol know my pawa and how I strong rish and dem go know sey na mi bi God.”


I go make sure sey Israel, my pipol know my holy name and I nor go let dem disgrace my name again. Den di pipol go know sey na mi bi di God wey dey holy.”


God sey, “Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt. Una nor get anoda God apart from mi. Na mi dey save una.


I bi di Oga una God and una go make unasef pure kon dey holy, bikos I dey holy. Una must nor dirty unasef.


God sey, “Israel pipol, una dey important to mi pass Ethiopia pipol? Just as I bring Filistia pipol kom out from Krete and Siria pipol kom from Kir, na so too, I bring una kom out from Egypt.


Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.


Make all glory, majesty, pawa and authority, bi God own, naw and forever thru Christ wey bi awa Oga God. Amen!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ