18 But God sey, “Make una nor tink about wetin dey happen or put una mind for wetin don happen before.
Make una remember all di mirakles wey E do, en wonderful works and di way E take dey judge,
Make una remember wetin happen before-before! Na mi bi God and e nor get any oda god. Yes! Na mi bi God and nobody bi like mi.
God sey, “I go kreate new heavens and new eart. Nobody go remember di tins wey don happen before and e go komot from dia mind kpata-kpata.
Wetin get glory naw, nor get glory again, bikos di glory wey di Spirit wey dey kom afta am get, big well-well.
So, if any man dey inside Christ, e don dey new, Christ don klean di bad tins wey e do before and evritin don turn to new one!
Make una nor fear. Make una remember wetin di Oga una God do to Fero and Egypt pipol;
Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not.