Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 43:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 God wey make road pass di sea and where wota dey, dis na wetin E tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 43:16
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu divide di sea for yor pipol kon lead dem pass for dry groun. But Yu make di wota swallow di pipol wey dey porshu dem and dem kon sink like stone.


E kommand di Red Sea make e dry kon take Israel pipol cross am like sey na desert


Yu waka on-top di sea go diliver yor pipol kon strol pass di great river, but nobody fit si yor footstep bikos e nor show at-all.


Den Yu use Moses and Aaron take lead and guide yor pipol like many sheep.


For der, E divide di sea kon take dem pass as di wota stand up like wall!


But make yu yorsef raiz yor stik kon take am divide di Red Sea, so dat Israel pipol go waka pass for dry groun.


But Israel pipol waka pass di sea for dry groun and di wota form wall for dem, both for dia rite and left side.


Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.


Na mi kommand di sea make e dry and e dry own.


Why my pipol nor ansa wen I go meet dem sey I go save dem? Why dem nor ansa wen I koll dem? I nor get pawa rish to save dem? But I fit kommand di sea make e dry kon turn river to desert, so dat di fish dem go die.


Na Yu dry di sea kon make road for inside wota, so dat di pipol wey Yu won save, go fit waka pass for dry groun.


Na mi bi di Oga wey bi una God, I dey shake di sea kon make di wave shaut. My name na God wey get pawa!


God don promise Israel pipol sey, “E go give dem sun as lite for day time, while di moon and star go dey shine for nite. E sey, E go shake di sea and di wave go roll on-top each oda. En name na God wey dey mighty.”


Den di sixt angel pour wetin dey en basin put for River Eufrates. Di river dry and road kon dey for di kings wey dey kom from east.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ