God sey, “Dis na wetin yu go do, so dat Israel pipol go bilive sey na di Oga God wey bi dia grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob God, appear to yu.”
Una don hear and si evritin wey I tok sey go happen. Una go fit deny sey I nor tell una before? From naw go, I go tell una new tins wey go happen, wey una neva hear or know about before.
so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.