Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 42:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Israel pipol, una don si many tins, but wetin dem mean to una? Una get ear to take hear, but wetin una don really hear?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 42:20
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So anybody wey get sense, make e learn from all dis tins and tink about how God good rish and en love wey nor dey fail.


Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”


Dem dey woship mi evriday dey sey, dem won know my ways and obey my laws. Dem sey make I just dey give dem my laws, bikos dem dey happy to woship mi.”


So E tell mi make I go give di pipol dis message: “E nor get as una go listin rish, una nor go undastand. E nor get as una go look rish, una nor go know wetin dey happen.”


So I ansa, “If I go warn and tok to dem, na who go gri listin? Dia ear block, so dem nor go hear mi, bikos God word dey make dem vex well-well and dem nor like am at-all.


So all di pipol gada kom listin to yu, but dem nor gri do wetin yu tell dem. Dem sey dem dey do di rite tin, but dem dey always dey shit and tif pipol money.


To dem, yu bi like pesin wey dey joke, sing love song or play harp. Dem dey listin to evry word wey yu tok, but dem nor dey obey any one.


non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi.


Naim make I dey tok with parabol sey: “ ‘Dis pipol get eye, but dem nor dey si, dem get ear, but dem nor dey hear or undastand.’


Yu wey dey tish odas, why yu nor fit tish yorsef? Yu wey dey prish sey make pipol nor tif, yu sure sey yu nor dey tif?


But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ