But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.
Aaron kollect and melt di gold kon mold melu for dem. Wen di pipol si di melu, dem kon sey, “Israel pipol, dis na di god wey lead us komot from Egypt.”
Dem kwik-kwik turn komot from di way wey I kommand dem o-o! Dem melt gold take make melu for demsef and dem don dey bow and offa sakrifice to am sey, ‘Israel pipol, dis na awa god wey take us komot from Egypt.’ ”
Si, shame go follow evribody wey dey woship dat god, bikos na human being make am. So make dem kom make wi judge di kase, den una go si sey, fear go katch dem and dem go disgrace demsef.
“Pipol wey dey make juju nor mean anytin and di juju wey dem tink sey dey give dem happiness, nor mean anytin at-all. Di pipol wey dey serve di juju nor dey si and dem nor know anytin; so na shame and disgrace go follow dem.
I dey tell una sey, doz wey woship and obey mi, go get plenty food to chop and drink, but food and wota go hongry una wey dey disobey mi. My pipol go dey happy, but na disgrace go follow doz wey dey disobey mi.
But God ask, “Na wetin I dey si so? Dem dey turn back, bikos of fear. Babilon sojas win dia sojas and dem kon run. Dem fear kon kwik-kwik run and dem nor even look back.