Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 42:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 I go distroy di hills and mountins kon make di grass and trees dry. I go turn di river to desert kon dry all di place wey wota from dey flow.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 42:15
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Fear kon make di pipol for di eart dey shake. Di mountins foundashon kon dey shake too; dem dey shake bikos God dey vex.


I go make una bi like new swod wey get sharp korna. Una go distroy all una enemies and di mountins and hills go skata for groun like dust.


Na mi kommand di sea make e dry and e dry own.


I go turn all my mountins to betta road kon prepare road for di hills, so dat my pipol go fit travel pass.


Why my pipol nor ansa wen I go meet dem sey I go save dem? Why dem nor ansa wen I koll dem? I nor get pawa rish to save dem? But I fit kommand di sea make e dry kon turn river to desert, so dat di fish dem go die.


As I look di mountins, dem dey shake like man wey dey fear and all di hills dey go back and front.


I go vex kon sey, ‘For dat day, many eartkweke go happen for Israel.


All di fish, bird, animal; weda dem big or small and evry human being wey dey stay dis eart, go fear mi well-well. Mountins go fall; high hill go skata and evry wall go fall skata too.


Dis na wetin Oga God for heaven dey tok: E nor go tey again before I go shake di heavens and di eart, di sea and di dry land.


Dem go cross rof river and I go stop di wave and Nile River go dry finish. Assyria wey bin dey karry body up, go honbol demsef and Egypt wey dey strong, nor go get pawa again.


For dat same time, betta eartkweke go happen and if dem divide di town into ten, one part go distroy finish. 7,000 pipol go die for di eartkweke and evry oda pesin go fear kon bigin tank God wey dey heaven.


Den di sixt angel pour wetin dey en basin put for River Eufrates. Di river dry and road kon dey for di kings wey dey kom from east.


Den tonda lite, like lion vois kon dey make nois and strong eartkweke kon happen. Dis kind eartkweke neva happen since wen God kreate di world.


Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ