Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 41:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 All dis gods dey yuzles; dem nor fit do anytin at-all. Di juju dem dey weak and konfuse and dem nor get pawa at-all.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 41:29
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Oda nashons god, na just juju dem bi, but na awa God make di heavens!


Dem nor go put dia hope for di altar wey dem make with dia hand or trust Asherah juju or di incense altar wey dem still make with dia hand.


Juju still full dia land too and dem dey woship tins wey dem use dia hand take make.


e burn all dia gods wey nor bi god at-all, bikos dem bi image wey human being use dia hands make.


Una with evritin wey una dey do, nor mean anytin. Na yeye pipol dey woship una!


Dem go karry am for dia shoulder dey waka kon go put am for where e go dey. E nor go fit komot for where dem put am. Even wen pesin pray to am, e nor go fit ansa or save di pesin from wahala.


Just as no one among di juju for dis nashon fit bring rain, na so too di sky nor fit make rain fall by ensef. So wi don put awa hope for yor hand. Na Yu bi awa God, bikos na only Yu fit do all dis tins.”


All wetin di profets tok nor mean anytin. God nor tok thru dem, so make wetin dem tok, happen to dem.”


Na wetin juju dey good for? Nor bi sometin wey pesin make with en hand? Na wish good e do wey go make who make am, trust am? Na god wey nor fit tok!


Pipol dey go meet juju priest and doz wey dey si tumoro, but dem just dey lie and deceive dem. Some dey tok wetin dreams mean, but dem dey only deceive una and na only yuzles hope dem dey give. So many pipol dey waka anyhow like sheep wey waka lost. Dem dey trobol, bikos dem nor get who dey lead dem.


di five men wey go spy, enter di shrine karry di image wey dem karve, di efod and di juju dem. While di priest stand for di gate with di six hundred men.


Make una nor bigin follow tins wey nor mean anytin, tins wey una nor go gain from or tins wey nor fit save una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ