All doz wey bin fight mi, dem go si dia dead body for road. Di worms wey chop dem nor go ever die and dem nor go ever kwensh di fire wey go burn dem. Dia dead body nor go dey good for human being to si.”
All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.
Dat kind juju bi like image for farm where dem plant melon put. Di juju nor dey tok; dem must karry am waka, bikos e nor get leg. But make una nor fear dem, bikos dem nor go fit wound or help una.”
‘Anybody wey make juju or image to woship, na curse go follow dat pesin, bikos juju wey human being dey make, na sin to God. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
Una go burn dia juju for fire and una must nor like dia gold or silva. Una must nor take dem, if not dem go bi trap for una, bikos dem nor dey good to di Oga una God.
Any propaty wey God nor like, make una nor take am enter una house, bikos if una do so, God go distroy una just as E do to doz pipol. Make una make sure sey una nor do dat kind tin, bikos God go distroy dem.