Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 41:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Make una tell us wetin go happen, so dat wi go know before e happen. Make una tell us di tins wey una don tok before, so dat wi go shek dem kon si as dem go take happen. Abi una go tell us about wetin go happen for future?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 41:22
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make wi know who tok am before e happen, so dat wi go know sey di pesin dey rite? True-true, nobody among una tok am! True-true nobody among una sey na so e go bi! True-true, nobody even hear wen una dey tok!


“True-true, di tins wey I bin tok, don happen naw. So, I go tell una new tins naw, even before dem go start to happen.”


E get anybody wey bi like mi? Make e tok am! Make e kom out kon make mout for my front about wetin don happen since I kreate dis world and wetin go still happen! Yes, make e tok wetin go happen.


So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.


Make evribody for di world turn kom meet mi naw and una go dey save, bikos na mi bi di only God wey dey.


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


So, make all of una gada kon listin to mi! Wish one among una juju don tell una all dis tins before? Di sojas wey God choose go do wetin E plan against Babilon.


God sey, “I dey tok about di tins wey go happen before e happen. Den na wons I do dem and dem kon happen.


“I don tell una before e go happen, so dat wen e happen, una go bilive sey na mi bi Christ.


E go dey give mi glory wen e dey tell una di tins wey e dey hear from mi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ