Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 41:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 God wey bi Israel pipol king sey: “Di gods for di nashons, make una tok wetin dey una mind. Make una kom defend unasef!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 41:21
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go dey proud to tell God evritin wey I don do. I go waka go meet am like prince.


Naw, make yu stand like man kon ansa di kweshons wey I go ask yu.


Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.


Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.


God sey, “Una wey dey for far land, make una listin to mi! Make una kom meet mi make I give una new pawa! Make una kom tok to mi; make wi kom togeda kon setol di matter.


Na mi bi una God wey dey holy. Israel pipol, na mi kreate una and na mi bi una king.”


Make all di nashons gada togeda and make dem bring di pipol kom: Wish one of dia gods go fit tok wetin go happen for future? Who among dem bin tok wetin dey happen naw? Make dem bring dia witness wey go sey dem dey rite or di pipol wey go kon tell us sey dem tok di trut.


God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ