I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una.
Heavens, make una shaut dey happy! All di deep part for dis eart, make una shaut well-well! Make mountins and evry tree for di forest, shaut too, bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.
Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
Wen una si sey dis tins dey happen, una heart go happy and una go prosper like grass. Den una go know sey, ‘Mi wey bi God dey help pipol wey obey mi, but I dey vex for my enemies.’ ”
Na my hand I take make heaven and eart; dem with evritin wey dey inside na my own. Mi wey bi Oga God, don tok! I go bless di pesin wey dey honbol and dey ready to turn from sin kom meet mi; pesin wey dey fear and obey mi.
Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’
e go drive sinnas komot from en present, en pawa and en glory. Dat day, evribody wey bilive, go praiz am and true-true, una bilive evritin wey wi tell una.