17 Wen poor pipol and doz wey dem dey opress dey look for wota bikos dia trot don dry, den mi, wey bi God go ansa dem. Israel God nor go ever abandon dem.
But di pipol dey hongry to drink wota, so dem still komplain, “Wetin make yu take us komot from Egypt? Na to kill wi, awa shidren and awa animals with honga?”
I go stand wait yu on-top one rock for Horeb. Wen yu rish der, make yu nak di rock and wota go kom out for di pipol to drink.” Moses do as God kommand am and di eldas for Israel si evritin wey e do.
Una go stay for Zion! Jerusalem pipol nor go kry again. Wen God hear as una dey kry with pain, E go kom save and help una. Yes! E go ansa wen una kry for help.
I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.
Even bad animals go honor mi; jackals and ostrich go praiz mi wen I go make river flow for di desert, so dat di pipol wey I choose go get wota to drink.
Food and wota nor go hongry dem again. Sun and desert heat nor go burn dem again, bikos na di pesin wey love dem, go lead dem. E go lead dem go where wota for dey flow.
God sey, “All of una wey wota dey hongry, make una kom drink from dis wota! Una wey nor get money, make una kom chop! Make una kom drink wine and milk and una nor go pay anytin!
Den I go always guide and satisfy una with good tins. I go make una dey strong and well. Una go bi like gardin wey get plenty wota and like wota wey nor go ever dry.
God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.
I dey tell una sey, doz wey woship and obey mi, go get plenty food to chop and drink, but food and wota go hongry una wey dey disobey mi. My pipol go dey happy, but na disgrace go follow doz wey dey disobey mi.
Na my hand I take make heaven and eart; dem with evritin wey dey inside na my own. Mi wey bi Oga God, don tok! I go bless di pesin wey dey honbol and dey ready to turn from sin kom meet mi; pesin wey dey fear and obey mi.
E tell mi, “Dis wota dey flow go di east, den from der go Jordan River Valley kon enter di Dead Sea. Afta di wota don flow go di Dead Sea wey get salt taste, di sea go kon turn to fresh wota.
Naim e shaut, ‘Papa Abraham, make yu sorry for mi, abeg send Lazarus make e put en finger for wota kon tosh my mout, bikos I dey sofa inside dis fire.’
But e tell mi, “Di grace wey I give yu strong rish, bikos my pawa dey show wen yu dey weak.” So, I go boast well-well about how I nor dey strong, so dat Christ pawa go dey show for my body.
E still tell mi, “God don do am finish! Na mi bi di Alfa and Omega, di startin and di ending. Anybody wey dey hongry for wota, I go gi-am wota wey dey give life and e nor go pay.
Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.