Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.
So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
Na mi wey bi God choose yu to show as I good rish. I go hold yor hands kon guide yu and I go give yu to my pipol Israel, just to fulfil my kovenant. And yu go bi lite to guide oda nashons.
Dis na wetin God tell Cyrus wey E choose, wey go use en rite hand distroy nashons, remove kings from pawa kon open gates so dat dem nor go klose am again:
My pipol, make una nor fear; make Israel pipol nor fear at-all. I go save una from di far land where una dey as prisonas. Una go kom back to una house kon stay for peace and nobody go make una fear again.
“So make my pipol, Israel nor fear! Make una heart nor shake. I go save una from dat land wey far wey una for bi prisonas. Una go kom back to una land kon stay for peace. Una go dey save and nobody go make una fear again.