1 God sey, “Una wey dey for far land, make una listin to mi! Make una kom meet mi make I give una new pawa! Make una kom tok to mi; make wi kom togeda kon setol di matter.
Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.
Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.
But pipol wey dey wait for God to kom help dem go get new strent and pawa. Dem go fly high like eagle; even wen dem run, dem nor go taya and wen dem waka, dem nor go faint.
Make all di nashons gada togeda and make dem bring di pipol kom: Wish one of dia gods go fit tok wetin go happen for future? Who among dem bin tok wetin dey happen naw? Make dem bring dia witness wey go sey dem dey rite or di pipol wey go kon tell us sey dem tok di trut.
So make una kom near mi and listin to wetin I dey tok: ‘Since I start to tok, I nor hide dey do am; so wen e go happen, I go dey here.’ And naw, Oga God wey get pawa don send mi with en Spirit.
bikos God dey near and E go show sey, I dey innocent. So, e get anybody wey go fit komplain about mi? Den, make wi go kourt togeda! Make e kom tok wetin I do!