Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 40:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 E dey give strent and pawa to pipol wey dey weak.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 40:29
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But en bow go dey strong and e nor go move and e hand go sabi work bikos of Jakob God, di Shepad, wey bi di Rock for Israel,


I si sey dem dey won make us fear, so dat wi go stop di work. But I pray kon sey, “My Oga God, make Yu give mi strent!”


Na God dey give en pipol strent and na en dey bless dem with peace.


bikos Yu dey stay with dem. My God, na yor blessing save doz wey dem dey opress.


God dey pawaful as E dey kom from en temple. Israel God dey give pawa and strent to en pipol. So make all praiz bi en own!


So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.


God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.


Doz wey don taya, I go give dem wota drink kon feed doz wey don weak bikos of honga.


I go make my pipol strong and dem go woship and obey mi.” Mi, Oga God, don tok.


So, make wi nor luz hope, bikos even if awa body dey die go small-small, di Pesin wey dey inside us, dey fresh evriday.


Una gate key go bi iron and bronze and God go guide una forever.


I fit do evritin thru Christ wey dey give mi pawa.


Wi still dey pray sey una go dey strong with God pawa wey get glory. Una go show sey una dey patient and get strong mind for God work with happiness.


kwensh fire wey dey burn well-well and eskape wen dem won kill dem with swod. God turn dia weakness to pawa. Dem strong well-well for war front and sojas from oda kountries, dey run from dem.


So God allow wota kom out from one place for di groun for Lehi, den Samson drink until e beleful. So e kon koll di place “En-Hakkore” and e still dey for Lehi till today.


Sojas swod don break to pieces, but doz wey dey weak, God dey make dem strong again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ