Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 40:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 So, Israel pipol! Why una dey komplain sey God nor know una trobols or kare if una dey sofa at-all?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 40:27
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E go do wetin E don plan for mi. Na-im dey kontrol my destini.


“As long as God Almighty wey nor gri judge my kase kon make my life bitter dey alive,


Job sey en know do bad tin and God nor gri defend am.


Oga God, na Yu bi my God! I go praiz yor name kon show as Yu good rish, bikos Yu don do wonderful tins and na as Yu tok before-before, na so Yu do am.


God sey, “Israel pipol, make una remember sey una bi my savant and I nor go ever forget una.


But Jerusalem pipol sey, “God don abandon us! Di Oga awa God don forget us.”


So I ansa, “I don work well-well, yet my work nor mean anytin! I use all my pawa, but I nor gain anytin.” But I still bilive sey, God go defend and reward mi for evritin wey I don do.


I vex leave una small, but I go show una my love forever.” Na so God, wey save una, tok.


David kon tink am sey, “One day Saul go kill mi. So, di best tin wey I go do naw, na to run go stay Filistia pipol land. Den Saul go stop to look for mi for evriwhere wey bi Israel own and I go free from en wahala.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ