23 Na-im dey make rulers rule with pawa kon still bring dem down.
E dey honbol priests and ova-trow doz wey dey pawa.
E disgrace princess kon take pawa komot from rulers hand.
God nor sorry for dia prince, instead E make dem dey waka for di dry and empty land.
E dey honbol prince and kings for dis eart, dey fear am.
Di day dey kom wen God go honbol proud pipol kon disgrace sturbon pipol. Den na only God, pipol go dey praiz.
True-true, God wey dey lead di sojas for heaven don plan di day wey E go judge evritin, bikos E go disgrace di pipol wey feel sey dem get pawa and dey make mout.
Na God wey dey lead heaven sojas do am. E do am to stop dia pride and to ponish dia pipol wey oda pipol dey respet.
En kings and leaders nor go get anywhere to koll dia kingdom again and all en ofisas go disappear.
Pipol wey tink sey dem wise and get sense, bi like doz wey don die.
I go kill all dia rulers and leaders.” Dis na wetin Oga God tok.