Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 40:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Na di Pesin wey sidan for di throne, make am. Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky. Pipol for groun, small like ants for en eye. E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 40:22
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sey, “Make di wota divide into two, so dat space go dey di middle.”


Yu feel sey as di kloud tick rish, God nor go si as E dey waka for heaven?


God spread di sky for nort kon hang di eart for empty space.


Nobody know how tonda take dey make nois for di sky or how kloud take dey waka for heaven where God dey.


yu fit help God bring di sky kom out kon make am strong like iron wey dem polish?


Na only en make di heavens kon waka on-top wave for sea.


Yor dress dey shine like lite and Yu stresh di sky like curtain for heaven;


E kon hide ensef for darkness and na di strong dark kloud E take round ensef.


yet dia vois don rish evriwhere for di eart and dia word don pass evriwhere for di world. God don build house for di sun for heaven


But di King wey dey heaven dey laf dem anyhow. Yes! God dey laf dem well-well.


Na God dey rule ova wota and E go bi king forever.


bikos na en bi di Pesin wey dey di sky from one generashon go rish anoda! Si! Na-im dey make dat loud tonda nois.


I dey der wen E put di sky for where e dey kon draw di boundary between eart and sea.


Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.


“Israel God wey get pawa; di Pesin wey sidan for where high pass di creatures wey get feadas. Na only Yu bi God wey dey rule all di kingdoms for dis world. Na Yu kreate di eart and di sky.


Si, di nashons nor mean anytin to God, dem bi like one drop of wota. Di island wey dey for far nor heavy rish dust for God hand.


All di nashons nor mean anytin to am at-all. For God eye, dem nor mean anytin at-all.


E nor go luz hope or start to fear. E go bring betta judgement kom evriwhere for di world and pipol for far-far land, dey wait make E kom tish dem.”


God wey kreate heaven kon stresh am out, wey make di eart and evribody wey dey inside, di Pesin wey give life to di pipol wey dey di eart and spirit to doz wey dey waka inside sey,


Dis na wetin God wey save una, di Pesin wey form una for una mama belle dey tok: “Na mi bi God wey kreate evritin. Na only mi stresh di heavens kom out kon design di eart as I wont.


Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


Na God make di eart with en pawa; na-im wisdom and undastandin E take kreate di heavens and eart.


Dis na God message about Israel. Na God kreate di sky and di eart kon give life to man. God sey,


and wi even si some giant for der (wey bi Anak shidren-shidren) and wi bi like ant for dia front.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ