Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 40:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Una nor know? Dem neva tell una since? Una neva hear how di world take start?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 40:21
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.


God spread di sky for nort kon hang di eart for empty space.


Pipol wey dey make juju and all doz wey trust dem and di juju, bi like di juju wey dem make with dia own hand.


Make di heaven tok about how E take dey judge bikos na God go judge by ensef. Make di heavens tok about en good judgement, bikos na God bi di judge.


Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.


So, yu neva hear sey na so I plan all dis tins since? And naw, I don do am; bikos na mi give yu pawa to take skata all di towns wey dem protet.


Una nor know? Una neva hear? God go dey forever. Na-im kreate di whole world. E nor dey taya or weak. Nobody fit undastand wetin E dey tink.


E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”


Una wey dey tok against God, make una remember and tink of all wetin God don do.


Na my own hand I take make di eart foundashon kon spread di heavens with my rite hand and wen I koll dem, all of dem dey stand kom togeda.


Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.


but E nor stop to do good for una, E dey give una rain from heaven and food from groun, so dat una go chop and belle go sweet una.”


Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ