Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.
So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?
Dem go drive yu komot from where human being dey and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu kon sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.”
I don turn to fool! Na una force mi, bikos una suppose to praiz mi. Even if I nor bi anytin, e nor get anytin wey doz una “supper apostles” take betta pass mi.