Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 40:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Si, di nashons nor mean anytin to God, dem bi like one drop of wota. Di island wey dey for far nor heavy rish dust for God hand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 40:15
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na dem bi di grand-grand papa to di pipol wey dey di land wey wota surround. Na dem bi Jaflet shidren-shidren.


So, make yu nor trust wetin yu get thru opreshon! Nor put hope for wetin yu tif! If yor money many, make yu nor too happy.


Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.


Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.


Even doh dis pipol dey make nois like heavy wave for sea, wen God shaut for dem, dem go turn run go one far land and na breeze go karry dem like leaf for hill or like dirty wey strong breeze blow.


So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?


Jerusalem, all di strenjas wey attack yu and di sojas wey make yu dey fear, na wons God go blow dem komot like ordinary dust.


Na di Pesin wey sidan for di throne, make am. Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky. Pipol for groun, small like ants for en eye. E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.


Pipol from far place si wetin I do and fear katch dem; di whole eart dey shake; all of dem gada dey kom fight.


E go ponish en enemies akordin to wetin dem do; even doh dem dey stay for far place.


and dem go know sey na mi ponish dem. “But I go send some of dem go far nashon wey neva hear how I dey great rish or si di great tins wey I dey do. Na with my pawa, I go take send dem go Spain, Libya and Lydia with dia strong men. I go send dem go Tubal and Greece and na dem go tell doz nashons how I great rish.


But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.


Den e go attack and konker many nashons wey dey near di sea. But one ruler from anoda kountry go win am kon stop all di nonsense wey e dey do since. All di yeye tins wey Siria king don do, di ruler go do am to am too.


Dem go drive yu komot from where human being dey and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu kon sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.”


Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


God go make dem fear as E dey distroy all di gods for di land.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ