12 E get anybody wey fit pak wota for hand kon measure am? Abi who fit measure di sky? Abi anybody don fit weigh all di san for di eart or weigh di mountins and hills with skale?
Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!
Dis na wetin Oga God tok: “Just as nobody go fit measure di heavens or open di eart foundashon, na so too I nor go ever rijet Israel pipol bikos of wetin dem do. Mi, wey bi God, don tok!”
“Na mi God kreate di mountins and breeze. I allow human being know wetin I dey tink. Na mi dey bring darkness to take kover lite and I dey waka on-top di hill. Na mi bi God and na mi get all di pawa.”