Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 4:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 For day time, God glory go kover di town from strong heat kon protet am from heavy rain.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 4:6
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos E go must guide mi wen trobol kom kon hide mi for en temple. E go put mi on-top one high rock where nobody go fit tosh mi.


I go kwik run go where I go dey save from dis pipol wey hate mi well-well.


Pipol wey dey stay where di Most High God dey, go dey save under en shadow.


God name na strong place to hide put, raitious pipol dey run enter and dem dey-dey save.


How una go take ansa di messenjas wey dey kom meet una from Filistia land? True-true, God don make Zion great and en pipol wey dey sofa, go dey save for der.


bikos na Yu dey protet poor pipol and doz wey nor get anytin. Yu dey protet dem from rain kon kover dem from hot sun, bikos di way wiked pipol dey bihave, bi like heavy rain wey dey fall.


God go shaut well-well kon fight with pawa. Yes! E go vex kom with fire wey dey distroy, heavy rain and with big-big stone wey dey fall from heaven.


Di time dey kom wen one king go rule well and di leaders go dey judge well too.


Dem go bi like house wey pesin hide put bikos of heavy rain. Dem go bi like wota wey dey rush for desert; like big rock wey en shadow kover empty land.


Bikos I dey holy; I bi like stone wey dey fall pipol and rock wey dey make pipol stagga. Yes! I bi like trap wey go katch pipol for Jerusalem.


“Naw, make yu tell doz wey dey with yu wetin I dey tok so. Na mi send dem go stay for strenj land kon skata dem for evriwhere. Yes, I go still dey with dem for di land wey dem dey.


Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.


God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.


Hongry nor go ever katch dem again. Dem go always get wota to drink; sun nor go ever beat dem again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ