Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 4:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 For di last days, seven wimen go hold one man kon sey, “Wi go feed and buy klot for awasef, but make yu just let us koll yu awa husband, so dat pipol nor go laf us, bikos wi nor get husband.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 4:1
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Rashel get belle kon born boy. Den Rashel sey, “God don take my shame komot.”


Bikos of dis tin, Mikal wey bi Saul pikin, nor born any pikin till e die.


But time dey kom wen Israel pipol wey go survive nor go depend on di pipol wey almost distroy dem. Instead dem go only depend and trust Israel God wey dey holy.


Just as pure gold nor plenty, na so too di pipol wey go survive, nor go plenty.


Wen dat day rish, pipol go trust God wey kreate dem; dem go depend on Israel God wey bi di King of all kings.


Di day dey kom wen God go honbol proud pipol kon disgrace sturbon pipol. Den na only God, pipol go dey praiz.


For dat day, God go distroy doz wey dey karry body up kon disgrace sturbon pipol and na only en name pipol go dey praiz.


Time dey kom wen pesin go hold en broda hand kon sey, “Since yu get yor own klot to wear, na yu bi awa leader. Den yu go fit kontrol all di wahala and trobol wey wi dey face.”


Make una nor fear, dem nor go disgrace una again. Make una nor fear at-all, bikos una nor go face shame again. Una go forget una shame wey happen wen una dey small and una nor go remember di sofa wey una sofa wen una nor get shidren.


Wimen wey dia husband go die, go plenty pass san-san wey dey near wotaside. I go kill una yong men for aftanoon kon make dia mama sofa. Na mi make dem dey sofa and fear go katch dem well-well.


So Elizabet kon sey, “God don do big tin for mi for my old age, E don favor mi for pipol present and E don komot shame for my face.”


bikos na dat time God go judge di world, since evritin wey dem rite for God word, must happen.


Wi dey kommand and enkourage dis kind pipol with awa Oga God Jesus Christ name sey, make dem do dia work well, so dat dem go fit feed demsef.


Peninnah dey always laf and make yanga for Hannah, bikos God neva give Hannah shidren.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ