8 For di place wey Ahaz build, God go make di sun shadow go back ten times.” So di shadow kon go back ten times.
For dat time, one kind bad sickness katch King Hezekaya. E pray give God and God show am sign sey, e go well.
Wen Babilon ofisas send pipol go find out about di sign wey happen for di land, God kon leave di king alone, so dat E go fit test am, make E for know wetin dey en mind.
Afta King Hezekaya don well, e kon rite dis song take praiz God:
“Make yu ask God wey bi yor God make E show yu sign. Di one wey go make yu bilive sey God don tok. Yu fit even ask make E do mirakle for yu.”
Di Farisee and Sadusi pipol kom test Jesus. Dem ask am make e show dem sign from heaven.
Gideon sey, “If yu go really help mi, den make yu show mi sign, so dat I go know sey na di Oga God really dey tok to mi.