I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”
All dis tins dey happen, so dat yu go fit tell yor shidren and grand-shidren how I take fool Egypt pipol with my mirakles, make dem for know sey na mi bi God.”
Make una tish dis kommand to una shidren. Make una tok about dem wen una dey house and wen una dey for road, even wen una won sleep and wen una wake-up.
Make una nor forget di day wey una stand before di Oga una God for Mount Horeb where E for tell mi sey, “Gada all di pipol kom meet mi, so dat I go tell dem my kommand. Den dem go learn to dey fear mi as long as dem dey alive and dem go tish dia shidren to dey fear mi too.”
But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.