18 Nobody wey don die go fit praiz Yu. Pipol wey don die nor go fit know how Yu good rish.
I dey pray to Yu, my God wey bi my rock. Make Yu ansa mi. Bikos if Yu kwayet, life go taya mi and I go kwik die.
“Wetin Yu go gain if I die? Wetin Yu go get if I enter grave? Dead body go fit praiz Yu?
Pesin wey don die, nor dey remember Yu. Na who go fit praiz Yu from inside grave?
I don taya to komplain, bikos evry nite, I dey wet my bed with wota from my eyes.
Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.
So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
Dem and all wetin dem get enter groun alive, den di eart klose against dem. So dem die komot di kommunity.
“So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”
But dem go trow di pipol wey suppose enter di Kingdom for darkness, where dem go dey kry and grind dia tit.”