12 Dem skata where I dey stay won kon take my life like tent wey dem pul from groun; like klot wey dem kut komot from machine. Yes! I bin tink sey God won end my life.
Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven.
Wi dey struggol as wi dey dis awa body. Wi dey karry heavy load, bikos wi nor won remove di klot wey bi awa body, but wi won wear heaven own join am, so dat life go swallow dis awa body wey fit die.