Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 37:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Dis na di message wey e send dem: “Today na trobol day, bikos dem don ponish and disgrace us well-well. Wi bi like woman wey won born, but wi too weak to even push.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 37:3
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Dis na wetin Hezekaya tok: ‘Today na bad day, bikos na curse and trobol full am. E just bi like wen woman wey get belle won born, but e nor get pawa to push di pikin out.


Bikos of dia sofa, dem kon turn go meet Israel God. Dem find am until dem si am.


Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”


Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem.


God sey, “Make una nor sturbon as Israel pipol do wen dem dey Meribah and Massah wey dey di wildaness.


But awa Oga God wey dey lead heaven sojas get di day wen E go kause wahala and konfushon for Vishon Valley and evribody go beg make di mountins kom help dem.


God wey get pawa go distroy and swallow deat forever! Doz wey dey kry, God go klean dia eyes and E go remove di disgrace wey en pipol don sofa for dis world. God, wey dey lead heaven sojas, don tok.


God, wen wi dey pass thru pain, wi kry, pray and look for Yu, bikos of di way Yu dey ponish us.


But mi God go bring wahala kom di town; dem go mourn and kry and e go bi like my altar where dem for dey do sakrifice.


So my God, make Yu sorry for us, bikos na Yu wi put awa hope on. Make Yu dey protet us evriday kon save us from trobol.


My holy town bi like woman wey just born pikin without sey e labor. E born boy pikin without pain.


Make una know sey I go kare for my pipol until dem go born. Yes! I go kare for dem until dem born di pikin.” God don tok.


Di day wen una go face sirious wahala dey kom and dem nor go fit kompare am with any oda day. Even doh di wahala go too mush for my pipol, dem go survive am.”


Israel get shance to live, but dem too dey foolish to si am; just like pikin wey dem just one born, wey nor gri kom out from en mama belle.


I go leave my pipol until dem don sofa well-well for dia sin, den dem go dey look for mi. Yes! Dem go really look for mi bikos dem dey sofa.”


Bikos Judgement Day dey kom wen dem go distroy Israel pipol. Wetin I dey tok naw, go really happen to una!


I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ