Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.
For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.
So God make King Pul for Assyria (wey dem still dey koll Tilgat-Pilneser) attack dia kountry. E karry Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe go stay for Halah, Habor, Hara and Gozan River and na der dem dey till today.